
Wetin to expect from President Tinubu visit to Benue state
Nigeria President Bola Tinubu dey expected to arrive Benue state, north-central Nigeria on Wednesday to condole wit pipo of di state afta one deadly attack wey lead to di death ova 100 pipo for Yelewata community for Guma Local Government Area of di state.
Di visit dey come for di middle of growing concerns as Nigerians dey worry say security for di region dey worsen.
Di presidency for one statement on Monday, 16 June confam say di president Tinubu go "clear im schedule and visit Benue state as part of renewed efforts to foster peace and address di persistent conflict affecting communities for di state."
Benue state goment for statement say dem ready gidigba to receive di president as di "visit no only represent a moment of national empathy, but na rare opportunity to directly follow di Presidency tok on urgent security interventions dem need to end di persistent killings and displacement of our pipo".
Wetin Tinubu go do for Benue state during im visit
Na for di midnight and early morning of Saturday, 14 June, suspected criminal herdsmen according to di state govnor Hyacinth Alia bin attack di community wey lead to di death of more dan 100 pipo die.
Di National Emergency Management Agency (Nema) tok say dia early investigation show say more dan 100 pipo kpai for di attack including two sojas and one officer of di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC).
Di number of pipo wey die fit still go up as di agency say di current figures still dey inconsistent sake of di volatile security situation and limited access to di affected areas.
However, e dey expected say di President during im visit go assess first-hand di recurring crisis wey don claim many lives and cause significant destruction.
During im stay, President Tinubu go meet wit all stakeholders—including traditional rulers, political, religious, community leaders, and youth groups—to find lasting solutions to di hostilities.
E go also hold town hall meeting wit all stakeholders during di visit.
In preparation for di visit, President Tinubu don already dispatch di Secretary to di Government of di Federation, di Inspector General of Police, heads of intelligence agencies, di National Security Adviser, plus di Chairmen of di Senate and House Defence Committees go Benue State.
SGF, Security Chiefs dey Benue to end killings
Ahead of di president visit, di Secretary to di Government of di Federation George Akume wey come from Benue land di state on Tuesday, 17 June.
E say im visit di sites of di attacks, meet wit survivors who express dia pains." Di pain dey raw, di sorrow dey deep," Di SGF tok.
"For di Market IDP camp, I meet families wey still dey suffer from di loss — displaced, grieving, and living in difficult conditions. Dia resilience moveme deeply. Dis crisis done go on for too long. No one deserve to live in fear or uncertainty for dia own homeland. Dis really hurt". Oga Akume add.
Di SGF assure say im no go abandon im own. "I go stand wit you- and we no go rest till our communities dey secure & peace return to our lands," e add.
Also, di Inspector General of Police Kayode Egbetokun and di Chief of Defence Staff Christopher Musa bin rush go Yelewata community on Monday to see tins for diasef.
Di IGP describe di attack as "senseless and an act of terrorism", and e promise say di Nigeria Police Force do dia best to bring di attackers to justice.
Also, di CDS assure di pipo say dis go be di last attack wey go happen for dia community.
"We want make dis one be di last one wey go happen. We go go all out to ensure say we address am. We don put measures for oda places and e bin work, so here no go dey different," e tok.
"I wan assure Nigerians say no be only Benue State, all ova di kontri, we dey determined, based on di mandate of Mr President, to make sure say we restore peace and tranquillity inside our country, but we need Nigerians to support us."

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
an hour ago
- BBC News
How di security palava Nigeria dey face fit affect food supply and price
As kasala dey increase for Nigeria, especially for northern part of di kontri, wia unknown gunmen, Boko Haram/ISWAP, bandits, herders and farmers dey clash, di place wey dem also sabi for big farming don dey face serious palava. As rainy season dey try reach im peak, farmers dey fear to go farm becos dem no wan risk dia life or make bandits kidnap dem. For recent weeks, kasala wey happun for North east, North west and North central don claim many lives and properties. Dis areas na places wey dey produce plenty food for Nigeria. Recently, Ministry of Agriculture for Nigeria release one internal memo wey tok say make dia staff fast for three days sake of food wahala for di kontri. Dis move show how serious di mata be. For 2024 alone, World Food Program report say kasala, insecurity, inflation and climate wahala go make hunger worse for Nigeria, and say 26.5 million pipo go face serious hunger. National Bureau of Statistics (NBS) tok say food inflation rate for October 2024 na 39.16% compared to 31.52% for October 2023. Experts believe say insecurity na one of di major reasons wey cause dis kain inflation. Experts still tok say goment need to do more to fight insurgency or find modern farming ways becos farmers for north dey fear to go farm. How security wahala fit affect food security and price dis year? Secretary of All Farmers Association of Nigeria (AFAN), Dr Yunusa Halidu, tell BBC Pidgin say insecurity na one of di reasons wey dey cause food wahala and food inflation. "Before dis insecurity wahala, many states for north dey farm plenty food, and food dey cheap for market," oga Halidu tok. "If no be for insecurity, Zamfara alone fit feed di whole kontri afta harvest." E believe say na insecurity cause di food inflation wey Nigeria dey face. "Lack of food na one of di reasons why food price rise for recent years, and na insecurity cause am. You know say di more pipo dey need sometin, di more di price go up," e tok. E mention say some northern states dey produce rice, wey Nigerians dey chop well-well, but rice and oda food production don reduce. "States like Borno, Yobe, Katsina, Zamfara, Sokoto and Kebbi sabi farm rice, but sake of insecurity, dem dey produce small rice now." Halidu add say "Na only Jigawa for all di northern states dey farm witout security wahala, sake say bandits no too dey dia." E still tok say if federal goment fit solve insecurity and provide farming support, Nigeria no go get food wahala and food go cheap for evribodi. Wetin be di solution? Dr Angarawai Ijantiku Ignatius wey sabi farming well-well and be Country Representative for International Crops Research Institute for Semi-Arid Tropics (ICRISAT) for Kano, tell BBC Pidgin say federal goment need to embraced and invest for modern farming. "But no mata di modern innovation, we still need land. But for small scale, we get wetin we dey call homegrown food. Pipo fit use bucket or cement bag put soil and plant yam, pepper or onion for house. E fit feed family of two or three." E tok say anoda modern way na make goment provide community-based place wey farmers fit plant and harvest. "We get new technology wey we dey call community-based farming programme, wia we go give farmers free training on di new method. How dem fit farm and harvest quick and distribute am for community," Dr Ignatius tok. "But for dis one, we need community vigilante to protect farmers." E also tok say dem suppose dey help farmers get fertiliser by using compost, since some places bandits no dey allow dem go outside village. But e still tok say homegrown food na just support, e no fit reach evriwia. On di oda hand, anoda expert wey sabi security mata for Kano, Dr Auwal Abdullahi, tok say Nigerian goment suppose try anoda way to fight insurgency. E tell BBC Pidgin say for over 10 years, goment dey use force fight insurgents, but e suggest say make dem try dialogue. "Make goment understand and work wit security pipo, community and gada intelligence. For farming season, goment need to work wit community and if possible, negotiate wit bandits" im tok. E say dis method work for Birnin Gwari local goment for Kaduna State. Dr Abdullahi also tok say if dem use peaceful method to tok to bandits make dem drop arms and stop banditry, kidnapping and cattle rustling, farmers go fit go farm and e go help Nigeria economy grow.


Daily Mail
19 hours ago
- Daily Mail
African gay men blame President Trump for their recent HIV diagnoses after he cut prevention funding
Gay men in Africa are blaming President Trump's decision to cut funding for HIV /AIDS prevention for their diagnoses of the virus. The administration's sweeping cuts to foreign aid have reduced access to medications like Pre-Exposure Prophylaxis, or PrEP, which decreases the risk of contracting HIV by 99 percent. Emmanuel Cherem, 25, a gay men in Nigeria, told Reuters that he tested positive for HIV two months after losing access to the US-supplied drug. 'I blame myself... Taking care of myself is my first duty as a person,' he said. 'I equally blame the Trump administration because, you know, these things were available, and then, without prior notice, these things were cut off.' Echezona, 30, another gay man from Nigeria, told Reuters that he took PrEP pills daily for three years until he was told by a clinic worker that the drug was now only available to pregnant and lactating women. 'I just pray and wish that Trump actually changes his policy and everything comes back to normal so that the spread and transmission of the virus would be reduced,' he said. Trump issued an executive order on his first day in office that paused foreign development assistance for 90 days, while Secretary of State Marco Rubio signed a 'stop work order' to employees of the State Department's Office of Foreign Assistance. The department oversees the US Agency for International Development (USAID) and the President's Emergency Plan for AIDS Relief (PEPFAR), which have seen drastic cuts since Trump took office. The administration has defended its position, arguing that other countries need to shoulder the burden of providing aid. During South African President Cyril Ramaphosa's White House visit, Trump acknowledged that the foreign aid cuts have been 'devastating.' 'Hopefully a lot of people are going to start spending a lot of money,' Trump added. 'I've talked to other nations. We want them to chip in and spend money too, and we've spent a lot,' he continued. 'And it's a big - it's a tremendous problem going on in many countries. A lot of problems going on. The United States always gets the request for money. Nobody else helps.' Russell Vought, the director of the US Office of Management and Budget, echoed Trump's stance during a Congressional committee meeting in early June. He argued that African countries should take on the responsibility of fighting HIV/AIDS, alleviating the financial burden on the US. Vought added that some of the nonprofits facilitating HIV prevention programs 'are not geared toward the viewpoints of the administration.' The director's comments are in line with a waiver issued to PEPFAR programs on February 1 allowing prevention programs to restart only for pregnant mothers. Vulnerable populations, like members of the LGBTQIA+ community, sex workers, or injecting drug users, weren't included in the prevention measures. PEPFAR grants often covered the cost of clinics supplying PrEP at public health centers for these populations, which have suffered closures due to decreased funding. A spokesperson for the State Department told Reuters that PEPFAR-funded programs would continue to be reviewed for 'assessment of programmatic efficiencies and consistency with United States foreign policy.' Public health officials and activists fear that if Trump's hardline policy toward foreign aid stays consistent, HIV infections will continue in the region. Linda-Gail Bekker, an HIV expert at the University of Cape Town, said that African countries may not cover the expense of supplying the drug, leaving a gap for more diagnoses. 'It's as predictable as if you take your eye off a smoldering bushfire and the wind is blowing: a bushfire will come back,' she told Reuters. Countries like Malawi, Zimbabwe, and Mozambique were almost entirely dependent on US funding for HIV prevention measures, according to UNAIDS. Other countries, like Ethiopia, responded to the USAID funding cuts by introducing a new payroll tax to pay for HIV medication previously provided by US funding. Medical advancements for HIV prevention and treatment have progressed significantly in recent years. However, UNAIDS projects that gaps created by a lack of funding could see steps backward.


Reuters
21 hours ago
- Reuters
Dutch launch operation Orange Shield to keep NATO summit safe
AMSTERDAM, June 20 (Reuters) - The Netherlands has launched operation Orange Shield to protect next week's NATO summit, deploying combat helicopters, sea patrols, over 10,000 military and police personnel, bomb squads and air defence systems. About 6,000 delegates and leaders from 32 countries, including U.S. President Donald Trump, French President Emmanuel Macron, and British Prime Minister Keir Starmer, will attend the closed-off event at The Hague's World Forum. The Dutch navy will deploy seven frigates as part of the country's largest security operation. "The aim is to observe everything that's happening in the area, at sea, and in the air," commander of the Tromp frigate Dennis Oorburg told Reuters. Dutch counterterrorism chief Pieter-Jaap Aalbersberg told Dutch broadcaster NOS that cybersecurity risks were also being closely monitored. Heads of state and ministers from NATO countries will arrive at Schiphol Airport on Monday and be escorted to The Hague via a secure highway corridor. On Tuesday, Dutch King Willem-Alexander will host a state dinner for NATO leaders. Ukrainian President Volodymyr Zelenskiy, who is set not to attend the summit, has also been invited to the dinner but has not yet confirmed his attendance. The summit officially begins on Wednesday, with NATO boss Mark Rutte aiming to get consensus from leaders on a 5% defence spending target, demanded by Trump. But Spanish Prime Minister Pedro Sanchez has opposed the higher target. Protests are expected around the summit, including a planned highway blockade by Extinction Rebellion environmental activists and demonstrations against the war in Gaza and LGBTI+ hate speech. Police say protests will be allowed "within the limits of the law".