11 hours ago
Wetin we know about di attack for Oko Community of Anambra State wey claim lives
Authorities for Anambra, southeast Nigeria, don confam say unidentified gunmen do shooting wey kill pipo and injure some for Oko Community for di state on Thursday night.
Police tok-tok pesin for di state Tochukwu Ikenga for statement say di incident na cult clash and add say na two pipo die from di incident.
However, local reports say at least five pipo don die while some dey for hospital dey collect treatment.
Videos wey BBC News Pidgin sight show at least seven pipo on di ground wit wetin resemble gun shot injuries.
Di incident cause major kasala all over di community as plenti pipo scamper to safety.
One lecturer for di school wey speak to our reporter in confidence say di attackers kidnap two lecturers of Federal Polytechnic Oko, wey dey within di community.
E also confirm say one staff of di polytechnic dey for hospital dey recuperate from gunshot injury.
Ibe Nzimako wey be di tok tok pesin of Federal Polytechnic Oko tell BBC Pidgin say di incidents happen inside di school, say na within di host community e happen.
"We don confirm say di pipo dem kidnap na lecturers, we dey sure of one. Di victims of di shootings no be students" na so e tok.
E say kidnapping issue na something wey don dey ravage evriwia across di kontri.
Similar cult related incident happun for October 2024 for Nibo community wia over ten pipo die from gunshot wounds.
Dis latest incident dey happen few months away from di state govnorship election wey go happun soon.
Oko community dey few kilometers away from di hometown of di sitting govnor Charles Soludo wey from Isuofia community.