01-06-2025
Amaechi defend im decision say e no vote Tinubu, di tok about poverty and failure of goment
Poverty and how di current goment dey run Nigeria become di koko of discussion wen a former cabinet minister gather pipo for Abuja.
Rotimi Amaechi serve as minister for transportation for eight years under former Nigeria President Muhammadu Buhari.
Despite say im na member of di ruling party for Nigeria, di All progressive congress (APC), Amaechi no hesitate tackle di current goment of president Bola Tinubu.
"I meet President Tinubu for Yola and I tell am say I no go work for you and I no go vote for you," Amaechi tok for di event wey hold for Abuja.
Di programme na to mark Amaechi, a former Rivers state govnor 60th birthday wia most of di guests tok about di situation for Nigeria.
Di birthday wey turn to talking point begin trend for social media as di celebrate and politicians tok some tins kain tins.
Di fastest growing industries for Nigeria na politics and criminality
Di guest speaker, Dr Chidi Amuta wey tok about poverty as e dey affect Nigerians explain say for a democratic system, di more you dey closer to power di more you go dey closer to resources.
E say di two dey related sake of say di pipo wey need power for democracy always need di population wey be di pipo and most of dis pipo wey make up di population dey poor.
Im say who you vote into power dey relative to how you fit take prosper.
E add say di kind of democracy wey dey happun for Africa na "Democracy from di top na be sake of economic empowerment and revolution'.
E say poverty for Nigeria don get national security implications "we dey see see different kinds of crime, kidnapping, armed robbery wey no go end no mata how much you budget for am sake of say di fundamental issue na poverty,"
"Di fastest growing industries for Nigeria na politics and criminality, becos of di fast returns dem dey get from politics ... and politics don weaponise poverty"
According to him na why politicians fit go to any length to enta power.
Poverty dey overwhelm Nigeria - Cardinal Onaiyekan
Cardinal John Onaiyekan, former Archbishop, Catholic Diocese of Abuja wey be one of di panelists say di kain poverty wey Nigeria dey face dey 'degrading'.
"Dem born me into a poor family but our kind of poverty dat time bin get dignity.
Wen you dey inside poverty wey don remove your dignity from you sotay you no fit tink well again, how you wan take build a nation like dat?"
Cardinal Onaiyekan tok say na di greed of pipo dey cause poverty sake of say God wey create di world and di humanbeings inside tok for all religious books say im provide wetin go reach evribody.
"God don already provide of di needs of evri Nigerian wit reources wey go solve all our needs so we no suppose to dey poor, so poverty no dey natural.
Im say na pipo dey make pipo poor for a purpose wey be to control dem.
"Poverty no be only mismanagement , e dey criminal and blasphemous, you dey sabotage di plan and purpose for God to humanity and no be wetin prayer and fasting go fit solve.
Wetin go solve am na if di pipo wey dey manage our resources do am well to make sure say no pikin sleep wit hunger na only dem e go dey well wit us" im conclude.
'I bin no sabi wetin poverty be until I become Emir' - Sanusi Lamido Sanusi
Di Emir of Kano Sanusi Lamido chook mouth for di poverty mata as e say di statistic of povery for Nigeria dey veri bad, but di situation worse pass di numbers.
Im say you need to see poverty face to face bifor you go understand wetin e be.
"Wen you go any village, see di kain water dem dey drink, di kain house wey dem dey live, wen dem tell you say school dey for di village and na just two classroom di school get, wey no get roof and no teacher.
Wen you see malnutrition and see how dia pikin dem be, na dat time you go understand wetin poverty be."
Im say di poverty for towns like Lagos and Kano no be di real one, I ask if evribody love di pipo or dem just want to rule ova dem?.
"Di kwesion we go ask na weda we really love Nigerians as human being or we just love di name.
E conclude wit statement wia e say, "di pipo wey say dem wan stop poverty bifor Nigeria enta crisis in future, make dem stop becos Nigeria dey inside crisis already"
'Nigerians dey give power to pipo wey no dey competent to lead' - El Rufai
Nasir El-Rufai say time no dey enof to tok about all di work wey him and Amaechi don do togeda,.
From political conspiracies, di successes and di failures dia fights and settlements.
"Our last quarel na wen im lose di presidential primaries im bin dey blame me becos I suppose to be a magician, im tok say like say i support am im for win.
"As many pipo come meet me say my broda (Ameachi) dey vex for me, I tell dem say make dem wait, wen Nigeria enta big troubleim go comeback and we go work togeda.
"And see us for hia todega becos Nigeria dey inside di biggest trouble since 1914. We dey work togeda now, dey conspire to form coalition to see how we go take Nigeria back on track becos Nigeria dey off track"
For di subject matter, im add say im no beliv say politicians dey make pipo poor but di main problem na say Nigeria dey give power to pipo wey no dey competent.
Oda pipo wey showface na Wole Soyinka wey say im like di fighting spirit and consistency of Rotimi Amaechi na why im showface for di birthday celebration as be di chairman of di event.
Senator Seriake Dickson say make Nigeria leaders do more to build security and education and make dem make pipo well democratically.
Some top politians including former Vice President Atiku Abubakar, ex-Rivers Governor Rotimi Amaechi, former Kaduna State Governor Nasir El-Rufai, among odas – dey try form coalition.
E neva clear how dem wan take do am but dia plan na to remove president Tinubu.