a day ago
Who and who dey inside di team wey Tinubu gather to stop di attacks for Benue?
Nigeria President Bola Tinubu don set up one committee wey go help bring peace for Benue State.
Dis one dey come afta di killing wey happn for Yelewata community inside Guma Local Goment Area of Benue State, wia reports tok say dem kill about 200 pipo.
National Emergency Management Agency (NEMA) tok say thousands of people don lose dia houses sake of di recent attacks wey happun.
Who be pipo wey dey inside di team wey Tinubu gather to stop di attacks for Benue?
Brigadier General John Atom Kpera na retired Nigerian Army officer wey retire for 1985 afta e don serve for different positions for over two decades.
John Atom Kpera bin born on 3 January 1941 for Mbatierev, Gboko Local goment Area wey dey now for Benue State.
E go Katsina-Ala College, wey dem dey call goment College Katsina-Ala now, from 1956 go 1961 for im secondary school.
Afta e join army, e go Haile Selasie Military Academy for Ethiopia in 1962 for Military Cadet Training, and dem commission am as 2nd Lieutenant for Corps of Engineers in 1965.
E don hold different command and staff positions like Engineers Brigade Commander, Squadron Commander, Regimental Commander, and Commander, Corps of Engineers.
John Atom Kpera na the first Military Govnor of Anambra State for Nigeria from March 1976 to July 1978, afta dem create di state from old East Central State during military regime of General Olusegun Obasanjo.
Later, e come be Military Govnor of Benue State from January 1984 to August 1985 during military regime of Major-General Muhammadu Buhari.
George Akume wey dem born 27 December 1953 na former govnor of Benue State wey rule from 1999 to 2007.
Na im be di current Secretary to di goment of di Federation.
For 1999, Akume becom govnor of Benue State and e serve two terms of four years.
For 2007, e win election to represent Benue pipo as senator for Benue North-West for Nigeria Senate.
Akume win again as Senator for Benue North-West for April 2011 elections under Action Congress of Nigeria (ACN). E win again for Senate under All Progressives Congress (APC) for 2015. E becom chairman for Senate Committee on Army and senior member for Senate.
Akume get nomination and confirmation as minister of Federal Republic of Nigeria by Muhammadu Buhari.
On 2 June 2023, President Bola Ahmed Tinubu appoint am as Secretary to the goment of di Federation (SGF).
For May 2023, Akume collect Nigerian national honour Commander of di Order of di Nigeria (CON) from President Muhammadu Buhari.
Gabriel Torwua Suswam wey dem born 15 November 1964 na Nigerian politician and former Govnor of Benue State from 2007 - 2015.
For 1999 election, e contest for House of Representatives for Katsina-Ala/Ukum/Logo Federal Constituency, and e win under People's Democratic Party (PDP).
Dem appoint am as Chairman of House Services Committee, later Chairman, House Committee on FCT.
E contest again and win for 2003. On 3 July 2003, dem appoint am Chairman, House Committee on Appropriation, den for August 2005, dem appoint am Chairman, House Committee on Power.
For April 2007, e win election as Govnor of Benue State.
Suswam contest for second term for 26 April 2011 gubernatorial elections under PDP.
For 28 March 2015 general elections, Gabriel Suswam lose senatorial seat to Chief Barnabas Gemade of APC.
Samuel Ioraer Ortom dem born for 23 April 1961, na Nigerian politician, businessman, administrator and philanthropist. E be govnor of Benue State from 2015 - 2023.
E start school for St. John's Primary School, Gboko for 1970 but later go St. Catherine's Primary School, Makurdi for 1974.
E attend Secondary Commercial College, Idah for Kogi State for 1976.
E get General Certificate of Education and Diploma in Salesmanship.
E get Interim Joint Matriculation Board Certificate for 1995 and Diploma in Journalism for 1998.
E attend Benue State University wey e get Advanced Diploma in Personnel Management for 2001 and Master of Public Administration for 2004.
Ortom get Ph.D. from Commonwealth University, Belize.
2011.
E be PDP National Auditor before dem appoint am as Minister of State for Nigeria for July 2011.
For April 2015, e contest for Governor of Benue State and e win under APC.
For July 2018, Ortom talk say e don comot from APC because of internal party wahala.
For 9 March 2019 Benue gubernatorial election and 23 March 2019 supplementary election, Ortom win again as Governor.
James Ortese Iorzua Ayatse, Tor Tiv V dem born am for 12 May 1956. Na Nigerian academic wey be Paramount Ruler/King of Tiv Nation and president, Tiv Area Traditional Council and chairman, Benue State Council of Chiefs.
E become professor of biochemistry for im late thirties and later serve as vice chancellor for two Federal universities between 2001–2006 and 2011–2016. Na only im be first Tiv man wey do am.
As Tor Tiv V, Ayatse na first Tiv man wey rule im pipo as professor.
E attend LGEA School, Mbagbegba, Shangev-Ya and St Anne's Primary School Adikpo.
E attend secondary school for Goment Secondary School, Gboko.
Later e go University of Ibadan wey e get for Biochemistry.
E do im Master of Science for University of Calabar before e go University of Surrey, Guildford, UK as Commonwealth student wey e finish with Ph.D. for Biochemistry.
Tor Tiv later go back University of Calabar for MBA and e become professor of biochemistry – first Tiv man wey achieve that.