logo
June 12 in Nigeria: How e become public holiday and wetin dey hapun on dat day

June 12 in Nigeria: How e become public holiday and wetin dey hapun on dat day

BBC News11-06-2025

June 12 of evri year na national holiday for Nigeria as di kontri dey celebrate dat day as 'Democracy Day', but e no always be so.
Nigeria bin dey celebrate dia democracy day on May 29, di date wen di military hand over power to a democratically elected president for 1999. Di last of such handover bin happen on October 21st, 1979.
So for 18 years - 1999 to 2018 - Nigeria dey use May 29 to reflect on di journey from military dictatorship to democracy.
However, on 6 June, 2018, Muhammadu Buhari who be Nigeria President dat time, declare say Democracy Day go now be evri June 12, even though May 29 go remain di date for swearing in of new presidents.
According to Buhari, "June 12th, 1993, dey far more symbolic of democracy in di Nigerian context dan May 29th or even di October 1st (wey be Independence Day)".
So wetin happen on June 12 1993 and why e dey so significant?
June 12 1993: Nigeria "freest and fairest" election
Na on June 12, 1993, Nigeria organise election to choose president wey go take over from di military Head of State Ibrahim Babangida, wey be Major General for di Nigeria army dat time.
Dat election na "undisputedly di freest, fairest and most peaceful elections since our Independence", President Buhari tok for im statement of 6 June, 2018.
Na di general consensus for Nigeria, even though di military regime of Babangida later refuse to acknowledge di election result.
Di refusal of Babangida to uphold di election and hand over power to Moshood Abiola - wey evribodi agree say na im win di election - trigger a chain reaction of katakata for di kontri wey last for up to six years and even lead to di death of Abiola and im wife Kudirat.
M.K.O Abiola... Di man for di centre of June 12
Moshood Kashimawo Olawale (M.K.O) Abiola na business mogul and politician wey bin run for president on di platform of di Social Democratic Party (SDP) for di general election of June 12, 1993.
A chartered accountant by training, Abiola bin work for some international companies including Barclays Bank and Pfizer pharmaceuticals bifor e go into private business.
During di SDP primary election to choose di party flagbearer for di general election, Abiola defeat im two major challengers; Abubakar Atiku and Babagana Kingibe, wey e later choose as im running mate.
Abiola slogan for di election - 'Farewell to poverty' - bicom very popular wit di pipo across ethnic and religious divides.
On election day, Abiola defeat im rival, Bashir Tofa of di National Republican Convention (NRC). E even win for Kano wey be Tofa home state, anoda reason why many say di election bin dey free and fair
However, di Head of State dat time, Ibrahim Babangida cancel di election as e tok say one court bin don give order make di election no go ahead.
Later dat year, anoda army General, Sani Abacha, take ova power from Babangida and e still refuse to recognise di June 12 election. Dis cos ogbonge protest across Nigeria, and even di current President, Bola Tinubu, folo for di pipo wey lead protests to add pressure make dem swear-in Abiola as president.
One year later, for June 1994, Abiola declare imsef President of Nigeria, but Abacha immediately declare am wanted, arrest am and detain am.
On 7 July, 1998, Abiola die. Na dat same day dem suppose release am from prison afta di death of Abacha. E bin dey for one meeting wit some diplomats from di US wen e suddenly take ill afta drinking tea.
Some pipo suggest say na poison dem poison am, though autopsy show evidence of heart disease.
How June 12 become national holiday for Nigeria
President Muhammadu Buhari declare June 12 as Democracy Day and national holiday on 6 June, 2018, as e tok say di date get symbolism pass May 29.
"Di fact say di military goment of dat time no uphold di outcome of dat election (of June 12, 1993), no fit distract from di democratic credentials of dat process," Buhari tok.
E also declare say di Nigeria goment go give Abiola di honour of 'Grand Commander of di Federal Republic (GCFR), wey be di highest national honour for di kontri, wey na only former Presidents dem dey give am.
Dis na symbolic gesture to officially agree say Abiola bin win the June 12, 1993 election true-true, even though im no go dey listed as a former president of Nigeria.
However, bifor dis declaration, some states for di southwest region of Nigeria wia Abiola come from, bin don dey mark June 12 as public holiday in honour of Abiola.
Dis states include Lagos, Ogun, Ondo, Osun and Oyo. Abiola come from Abeokuta for Ogun State.
Wetin fit happen for June 12 dis year?
Normally, di president dey usually do a nationwide broadcast wia e go talk about Nigeria journey for democracy so far. Presidents day also use di opportunity to tok about some of di tins wey dia administration don achieve for di year and dia future plans.
For im democracy day speech of 2024, President Tinubu tok about di increase for di national minimum wage, and how im efforts to protect di rights, freedoms, and liberties of Nigerian citizens.
E dey expected say di president go also do anoda broadcast dis Thursday. E dey usually be by 7:00am.
Also, govment dey normally organise celebrations for di Eagle Square Abuja, wey go feature parades and march-pasts by various armed forces, and sometimes aerial displays by di Air Force.
On oda occasions, di celebration go dey low-key, wit a brief change of guard parade by di Presidential Guards Brigade for inside di Aso Rock Villa wey be di president residence.
E neva clear weda any such celebration go happen dis year.
Again, civil society organisations dey also use di democracy day celebration to organise rallies and peaceful protests against some actions of goment wey dem feel say e dey anti-democratic.
Already, di 'Take it back' movement, a civil society group wey dia leader na Omoyele Sowore, don declare nationwide protest for dis year June 12.
One of di tins wey dem say dem wan protest about na di killings for various parts of Nigeria, including Benue, Plateau, and Zamfara States.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Frik Potgieter and Peter Huxham return to South Africa from jail in Equatorial Guinea
Frik Potgieter and Peter Huxham return to South Africa from jail in Equatorial Guinea

BBC News

time2 hours ago

  • BBC News

Frik Potgieter and Peter Huxham return to South Africa from jail in Equatorial Guinea

Two South African engineers have returned home after spending more than two years in jail in Equatorial Guinea on what the UN has called "arbitrary and illegal" drugs Potgieter and Peter Huxham, both in their mid-50s, were arrested in February 2023 after drugs were allegedly found in their were sentenced to 12 years in prison and fined $5m (£4m) but have been given a presidential pardon after a long campaign by their families and the South African arrest came days after luxury assets belonging to Equatorial Guinea's Vice-President Teodoro Nguema Obiang were seized in South Africa. A yacht and two Cape Town villas belonging to Obiang, who is also the son of Equatorial Guinea's president, were impounded in execution of a court ruling."We are overwhelmed with relief and joy. The last two years and four months have been unimaginably painful for both of our families," according to a statement released by the two men's were working for the Dutch oil and gas company SBM in Equatorial Guinea when they arrested the night before they were due to return home after a five-week stint in the families had called for the assistance of the South African government as well as that of the UK government, as Mr Huxham has dual nationality."South Africa expresses its sincere gratitude to the Government of Equatorial Guinea for considering and ultimately granting this Presidential pardon, allowing Mr Huxham and Mr Potgieter to return home to their loved ones," said a post on X by South African Foreign Minister Ronald United Nations Working Group on Arbitrary Detention last year called for the pair's release, saying their detention was families say the pair were arrested in retaliation for the seizure of the assets belonging to Equatorial Guinea's BBC has contacted Equatorial Guinea for comment.A South African official told the BBC it was for the courts to decide the fate of the yacht and villas, and the government couldn't intervene. You may also be interested in: Equatorial Guinea VP's superyacht and homes seized in South AfricaThe president's son who loves Bugattis and Michael JacksonWorld's longest-serving president to continue 43-year-rule Go to for more news from the African us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica

Viral video catch wia pipo dey beat Rivers LGA Sole administrator, police take action
Viral video catch wia pipo dey beat Rivers LGA Sole administrator, police take action

BBC News

time2 hours ago

  • BBC News

Viral video catch wia pipo dey beat Rivers LGA Sole administrator, police take action

Rivers state police don condemn di attack on di sole administrator of Ahoada-East Local goment area, Goodluck Iheanachor and invite im chief of staff to come answer kwesion on di matter. Police claim say Hector Ekakita, wey be di chief security officer and di Chief of staff to di sole administrator allegedly storm di council secretariat wit 30 jaguda pipo, wey attack oga Iheanacho. Di attack happun on Friday 20 June for di council secretariat according to police. During di attack, di jaguda pipo beat di Sole Administrator, tiff im mobile phones, force am to sign im letter of resignation, den go away vital documents, including official and personal documents from im office, police tok. Dis incident dey happun few months afta im appointment by Vice Admiral Ibot-Ete Ibas di Sole Administrator of Rivers State. Police say Iheanacho dey hospital wia im dey currently collect medical treatment sake of di injuries wey e get during di violent attack. Im dey stable condition. Meanwhile di commissioner of Police, Olugbenga Adepoju, visit di scene of attack wit heads of oda sister security agency for di state and vow to take action. Viral video For di viral video, Honourable Iheanacho wear grey native sitdom for ground surrounded by di Jagudu pipo. Di jaguda pipo flog di sole administrator of Ahoada and shout on am to sign di document wey dem give am. Rivers state emergency rule Na March 18, 2025, President Bola Tinubu declare state of emergency for Rivers state and suspend di governor, im deputy and all lawmakers for di state parliament for six months. For one nationwide broadcast on Tuesday evening Tinubu say im receive "disturbing security reports wia im detail incidents of vandalization of pipelines by some militants without di govnor taking any action to curtail them". Im add say im no allow di "grave situation" to kotinu. But lawyers and opposition politicians dey kwesion di legality of di president decision. Tinubu bin make di announcement afta one of di kontri highest producing crude oil pipelines, di Trans-Niger Pipeline, bin suffer significant damage sake of blast. In di past criminal gang or militant don carry out attack on pipelines wey, halt production and exports. At current prices, the oil flowing through the affected pipeline fetches around $14m (£11m) a day, according to the online publication Africa Report. But against the backdrop of the blast, there has been a political rift in Rivers state that has reached boiling point. Govnor Siminalayi Fubara na member of di People Democratic Party wey dey face serious wahala. PDP na di main opposition party to di president's All Progressives Congress. Tinubu say politicians no bin fit work togeda effectively sake of di wahala. Im allege say Fubara allies bin threaten "fire and brimstone" against di govnor enemies and dem no "disown" dis comments. Rivers state lawmakers bin threaten to impeach di govnor and im deputy. Tinubu say dis political crisis don leave Rivers state im "standstill" im add say dis im move dey based on di need to restore peace and order for di state. Fubara react to di state of emergency, im say na "political disagreements, but good governance dey kotinu". "Rivers state dey safe, secure and peaceful under our watch," im tok. Di state of emergency allow di goment to run di state in di interim and dem go send security forces if needed.

Hopes ahead of ECOWAS 67th meeting, end of Tinubu tenure as Chairman
Hopes ahead of ECOWAS 67th meeting, end of Tinubu tenure as Chairman

BBC News

time4 hours ago

  • BBC News

Hopes ahead of ECOWAS 67th meeting, end of Tinubu tenure as Chairman

President Bola Ahmed Tinubu go host di 67th ordinary session of di Economic Community of West African States in Abuja. Delegates from member states Ecowas begin land for di Banquet hall of di state house, for di meeting on Sunday. Dis meeting dey happun six months afta di one wey happun for December 2024 and e go also mark di end of Tinubu two-year tenure as Chairman of ECOWAS. Na during di last meeting di bodi bin approve di exit of Mali, Burkina Faso, and Niger from di regional bloc. Nigeria ministry of Foreign Affairs bin announce say di summit aim na to deepen regional economic integration, address security challenges, and advance economic cooperation across ECOWAS member states. Dis 67th Ecowas summit go bring togeda West African leaders to discuss pressing issues, including democratic governance, regional stability, and ongoing efforts to reintegrate Sahelian states wey bin commot di bloc. Meanwhile, di West Africa Economic Summit (WAES), wey President Tinubu bin hold bifor di 67th ECOWAS summit focus on how to boost trade and investment cooperation across West Africa. Di programme see attendance from different West African leaders, including di Presidents of Ghana, Liberia, Sierra Leone, Senegal, The Gambia, Benin, Togo, and Guinea-Bissau. WAES dey aim to get ogbonge outcomes and deliverables wey go help fast-track West Africa integration agenda, wey dey key for regional peace, security, and prosperity. President Tinubu bin dey re-elected on 7 July, 2024, for a second term aft aim first tenure wey wey bin strat for 9 July, 2023. Military takeovers in West Africa and ECOWAS main challenge "Di recent wave of instability and military takeovers in our region no be just security concern—na economic emergency. We must defend democracy as a prerequisite for prosperity", dat na statement from Ghana president John Mahama during di West Africa Economic Summit for Abuja. Di president wey tok through Ghana finance minister during di WAES on Saturday, say economic integration and trade no fit thrive for atmosphere wey political instability dey. Mahama describe di recent wave of military coups in West Africa as no be just a threat to democracy but "economic emergency" wey undermine di region growth prospects. "Trade no fit flourish wia democracy dey retreat. Investment no dey land wia governance dey broken. "Let West African leaders recommit to constitutional order—no be as abstract ideal, but as a practical requirement for growth. We no fit unlock trade while our region dey locked in conflict," di president tok.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store